As from Monday, Nigerians go chop travel restrictions from di UK until further notice sake of di new variant of Covid wey be Omicron.
UK goment say dem don confam 21 cases of Omicron virus wey dey linked to travels from Nigeria.
Canada also say dem don discover many cases of Omicron for di kontri and e dey related to pipo wey travel enta Canada from Nigeria.
Dis don make Canada sama Nigeria travel ban wit some conditions.
Days later, di United States also announce strict travel rules wey affect many kontris including Nigeria.
For 1 December, 2021, Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) confam di first case of Omicron variant for di West African nation.
NCDC Boss, Dr. Ifedayo Adetifa for statement say dem identify two cases of of di Omicron variant from travellers wey enta Nigeria from South Africa.
For now, e neva dey clear how many cases di kontri don record since di first reported cases.
Wetin don change for Nigerians wey wan travel enta di UK, Canada and US?
For US, Under di details wey di Biden administration on Thursday announce, all international passengers go need test for di virus 24 hours before dem leave for di US, no mata dia vaccine status.
“I announce say all inbound international travellers must test within one day of departure, regardless of their vaccination status or nationality”, Oga Biden tok for inside statement.
Oga Biden also add say dem go extend di requirement, both internationally and domestically, to wear masks for travel on aircraft, trains, and public transportation all through di winter months.
Canada don sama travel ban to Nigerians till further notice. Dis one mean say dem no go allow pipo wey dey come from Nigeria enta di kontri except you get right of entry to Canada.
Authorities say Canadian citizens, permanent residents and pipo wey get status under di Indian Act na only dem fit travel from Nigeria enta Canada for now.
But no…